Love Poem: Kwarapshen - Corruption
Kelechi Francis Avatar
Written by: Kelechi Francis

Kwarapshen - Corruption

A Poem in Pidgin English

Me, ma na SARS
I sabi drop bars
My gun ready to blast
Any youth wey dey drive cars
If tattoos na your singlet
We go treat you like piglet
If you no gree cooperate
Omo, you go catch bullet.

Me ma na politician
If you check, I be magician
I dey "pight" my brand of "kwarapshen"
Play ball, I go give you admission.
My certificate na banza
My account balance na fire
If I like I go make yanga
Even next time I go still dey power.

Me ma na Naija
Our mumu don end here
Una plans go backfire
Na my generation go matter
Una vision dey our museum
And we ready to change our condition
Even if una kill small portion
We go still carry out our mission.

Lekki na the catalyst
We go use am minimize fatalities
We don learn all una tactics
And we have all the relevant statistics
Baba God na our confidence
Next election una go see our relevance
We dey ready- no more reluctance
2023 una go see proper sense.